How to stop to dey overthink in 5 seconds.
Our mind be like river and one
thing wey we sabi about rivers na say e go continue to flow to any direction
wey e choose and you no go fit do anything about am. But wait oh! Just imagine
say u fit construct one big tunnel wey dey connected to this your river-like
mind con direct the water to any where you choose am to flow go. You like that
levels abi?
Make we give you the informate
sharp sharp. Na the 3 ways to stop overthinking sharp sharp be this.
#1. Play confirm gbedu:
This method dey work instanta if
you do am the correct way. To play better gyrating music Good but na to play
the “right” music sure pass. Quick Quick grab one earpiece or headphone, play
that music wey dey make you dance
anytime any day.Play that song wey dey make you lose control, Play am Now Now!
#2. Watch Film:
Whether you wan use your android
phone or television sha make sure say u siddon watch that film wey you don dey
postpone to watch for long. And if you dey watch am ehn make sure say you
dey SELFISH
about am. Increase the volume wella and if you dey use your android phone make
sure say you put your earphone like a boss. If anybody wan disturb you
ehn…NO GREE! Give dem bad eye as dem
come near you. Dem self go fear. If dem no like am make dem go hug the nearest
transformer. E fit be like say your own don too much but the most important
thing now na YOU. After your mood reset ehheen you fit turn back to Mr.Nice
guy.
#3. Call your Sweetie
This method dey work wonders oh.
Your sweetie nko? Your boo, honey pie, sugar in your tea and heartthrob dey
somewhere na. Call am now now. Even if you no sabi how to describe how the
thing dey do you, just open ya mouth begin talk. Make sure say you pour your
mind out but small small. If you don do am at least you don take the matter off
your mind. Why? Because overthinking no solve the problem at all.
Na here we go stop to dey type.
Follow these confirm methods and you go see beta result. Your fit follow us for
twitter http://twitter.com/pidginblog
for more. Abeg no forget to leave comment below. Thank you.
Follow us on top Twitter @pidginblog
You no go regret am
No comments
Abeg No vex. Drop your comment for the matter.