Why you suppose to reduce the way you dey listen to news.
Close your eyes small imagine this one… You wake up for morning and you baff, clean house small and you say make you watch television small, You con say make you watch news sharp sharp and GBAM!. You hear the newscaster dey talk about the way dollar don high again, boko haram wahala ,politics corruption and the way price of fuel go up wella. Before you realize am time don reach.
As usual you enter motor and you begin drive go work. The next thing wey go dey your mind na to turn on the radio for early morning ginger and extra news about infomate and news. E no go tey before you hear say something bad don happen to some people for one area because of lack of security and the amount of money wey dem politicians don steal commot from we treasury.
Finally you reach your working place and everything go normal as usual until break period wen you begin yarn with your friends. Una go first start with normal discussion but later the discussion about money matter and salary increase, but before you know one frustrated guy go just begin talk about how owu dey blow am, about corrupt politicians and the bad economy.
But you na strooooong guy. E no mean anything to you. You dey on top of your game.
For you mind…
Small small, day after day for years we you go dey continuously hear this bad news and complaints, suddenly everylittle thing go begin irritate you and before you know am your happiness go just dey dry away small small.
Wetin you don de listen to?
News or Rubbish?
Dey Informed, that’s all.
We don select some reason why you suppose dey careful of the kind of news wey you dey listen to.
1. Bad news go make you lose desire to move forward in life.
2. Bad news go make you dey afraid of almost everything.
3. Bad news no go make you wan invest your money.
4. The yearly target no go clear again.
5. Food no go sweet as em dey sweet before sake of sake your mind no dey at rest.
6. Your wife or babe go suddenly turn to liability for your eyes.
7. You go find am very hard to lias with others because of suspicion.
God Forbid...You fit lose your mind sef.
Do yourself a favour, Control the yamayama wey you don dey listen to. Dey Informed but no believe everything wey those bad news mongers dey carry about. Your mental health dey important to us.
If you enjoy this conversation make you leave small comment below. We wan make you talk your mind for this matter too.
Follow us for twitter @pidginblog
You no go regret am
Nice one. I dey feel am
ReplyDelete